
Di President of Ghana, John Mahama don announce more ministerial appointments into im cabinet.
Mahama don dey make appointnents into key offices of im goment since after e take di oath of office on January 7, 2025.
Thursday announcement feature three pipo wey di President appoint as regional ministers and nine odas as ministers of state.
Here na di names and brief profiles of di new minsters:
Eduamoah Ekow Panyin Okyere – Central Region

Wia dis foto come from,Ekow Eduamoah/Facebook
Oga Okyere dey represent di Gomoa East constituency wey dey for di Central region of Ghana.
Im na graduate of Management Studies from di University of Cape Coast.
E first enta di Ghana parliament in 2008, win again in 2012 but lose im seat in 2016 bifor e come back again in 2020.
E dey 52 years old.
Wilbert Petty Brentum – Western North Region

Wia dis foto come from,Wilbert Brentum/Facebook
Oga Brentum na chartered accountant, politician and business person wey get experience for di mining industry for Ghana.
E come from Aowin Municipal District wey be one of di nine districts for di Western North Region of di kontri.
Joseph Nelson – Western Region
Joseph Nelson na sabi pesin for economic and finance matter and e don gather years of experience for dat sector for Ghana and even abroad.
E study for di University of Northampton, UK, wia e obtain im bachelors degree for Economics; e also get Master’s degree in International Finance and Economic Policy from di University of Glasgow, Scotland plus anoda Masters in Microfinance from di University of Cape Coast, Ghana.
Oga Nelson bin don work for goment as di Regional Director of di Youth Employment Agency (YEA).
Ministers of State
Di nine Ministers of State wey President mahama also announce on Thursday na:
- Kwame Governs Agbodza – Ministry of Roads and Highways
- Eric Opoku – Ministry of Food and Agriculture
- Agnes Naa Momo – Ministry of Gender, Children and Social Protection
- Abla Dzifa Gomashie – Ministry of Tourism, Culture and Creative Arts
- Emelia Arthur – Ministry of Fisheries and Aquaculture
- George Opare-Addo – Ministry of Youth Development and Empowerment
- Haruna Iddrissu – Ministry of Education
- Ahmed Ibrahim – Ministry of Local Government, Chieftancy and Religious Affairs
- Elizabeth Ofosu Adjare – Ministry of Trade, Agribusiness and Industry
Marathon appointments by Mahama

Wia dis foto come from,Justina Nelson/LinkedIn
Remember say on Wednesday, President John Mahama bin appoint former Chief of Staff Prosper Douglas Bani to be di National Security Adviser to di President.
Dis come afta series of appointments wey di president make on Tuesday.
Ghana President submit di names of di first batch of regional ministerial nominees wey e appoint give di Parliament for approval.
E also announce di appointment of Justina Nelson Acting Chief Executive Officer of di Minerals Income Investment Fund.
Mahama make three new appointments on Wednesday leading wit Bani as NSA.
Oga Bani, wey don also work as Minister of Interior bifor dey come wit plenti experience and knowledge for work.
DCOP Abdul-Osman Razak go service as di National Security Coordinator, wey go make sire say all security initiatives collabo to get one focus in terms of strategy.
Charles Kipo don dey named as Director General of di National Intelligence Bureau.
Dr. Frank Amoakohene – Ashanti region
President Mahama nominate Dr. Frank Amoakohene as di regional ministerial nominee for di Ashanti region.
Amoakohene na medical professional and youth leader. E be expert on healthcare, governance and public service.
E get Bachelor of Medicine and Surgery from di University of Ghana, Doctor of Medical Laboratory Science Degree from di University of Development Studies and MBA from di Accra Business School.
Currently, e be di Ashanti Regional Secretary of di National Democratic Congress.
James Gunu – Volta Region
James Gunu na di regional nominee for di Volta region. E be ogbonge media practitioner.
E hold Bachelor of Arts in Journalism, Master of Arts in Development Communication and Masters of Arts in Lcal Government Administration and Organization.
Oga Gunu na di former MCE for Akatsi.
Rita Akosua Awatey – Eastern Region
She be woman wey get plenty experience on governance, education, and community development.
She get MPhil in Leadership from di University of Professional Studies, Accra.
She get correct track record as local governance practitioner, afta she don serve as presiding member of di Yilo Krobo Municipal Assembly and Deputy Eastern Regional Women Organiser of di NDC.
She be seasoned educator and advocate for women empowerment. Currently, she dey pursue PhD in Migration for di University of Ghana.
John Kwadwo Gyapong – Oti Region
Oga John na business executive and former Member of Parliament for di Akan constituency.
Currently, e be di NDC regional chairmo for di Oti region.
E get Bsc in Education from di University of Cape Coast.
Akamuguri Atanga – Upper East Regional
Atanga, di ministerial nominee for Upper East region hold Masters degree in Human Rights and Bsc. In Social Studies and Mathematics from di University of Education Winneba.
Bifor di nomination, e bin serve as coordinator of di National School Feeding Programme and presiding member of Bongo District Assembly.
Ali Adolf John – Northern Region
Di educational professional don serve as teacher, circuit supervisor and desk officer within di Ghana Education Service structure.
Di regional ministerial nominee get Bachelor of Education and Masters in Technology from di University of Education, Winneba.
Currently, e be di Northern Regional Chairman of di NDC.
Madam Charity Gardiner – Ahafo Region
Madam Gardiner na businesswoman and Human Resource professional wit close to 10 years of experience.
She get strong credentials for non-profit, humanitarian work, wit special interest in girl child education and empowerment.
She get Masters and Bachelor degrees in Human Resources Management.
Salisu Be-Awuribe – Savannah Region
Oga Be-Awuribe, di regional ministerial nominee for Savannah region na man of many hats. E be lecturer in Law, lawyer, valuation professional and development expert.
E don serve as district Chief Executive for di Central Gonja District.
E hold professional certificate in Law from di Ghana School of Law, Masters in Law from di University of Ghana, B.sc in Land Economy from di Kwame Nkrumah University of Science and Technology.
Hon. Linda Ocloo – Greater Accra Region
Madam Ocloo na member of parliament wey dey represent di Shai-Osudoku constituency.
She hold B.sc in Administration (Banking and Finance option) from di University of Ghana.
Ibrahim Tia – North-East Region
Oga Tia na public health finance and local goment professional wit expertise in systems, management, public relations and health financing.
Di regional minister nominee get ogbonge experience, wey include im work wit di National Health Insurance Scheme, wia e rise from di position of district manager to deputy regional manager for di Northern Regional Office of di NHIA.
E hold B.sc degree in Information and Communication Technology, Post Graduate Diploma in Management Studies plus mini MBA in Project Management.
Oga Tia don serve as di regional secretary of di NDC for di North East region since 2019.
According to Ghana constitutional provisions, di Speaker of Parliament must approve ministerial appointments bifor dem swear dem into office.
Di house go carry out background checks and parliamentary vetting to ensure say di nominees dey suitable for di roles.