
Italy Prime Minister Georgia Meloni go see Pope for hospital, where dem diagnose am with pneumonia for both lungs. 88-year-old Pope enter Rome Gemelli hospital on Friday because of respiratory infection. Meloni talk say she dey very happy say she find am alert and dey respond. Dem dey joke like always. E never lose im famous sense of humour. She wish am quick recovery on behalf of Italian government and di whole country. Earlier this week, Vatican talk say medical tests and chest X-ray show ‘complex picture’.
Pneumonia dey serious infection wey fit inflame and scar di lungs, make chest dey pain and breathing dey hard. Vatican update on di Pope health talk say e dey alert and chop breakfast. Vatican official talk say di Pope still fit come out from bed and sit for armchair for im room, and e dey still fit do some work. E don cancel papal audience wey supposed hold for Saturday and e no well enough to attend Mass for Sunday. Outside di hospital, people wey wish am well and pilgrims dey gather dey pray, light candle and write notes of encouragement.