
Di mysterious drones wey light up di sky for US late last year dey authorized by federal regulators and dem no be enemy, di White House don announce. Di Federal Aviation Administration (FAA) don approve di drones for research and plenty of dem belong to piple for di area, President Donald Trump’s press secretary, Karoline Leavitt talk for her first White House briefing on Tuesday. Di drones waka for New Jersey and oda nearby states for November and December, wey make pple online start dey speculate about where dem come from and wetin dem wan do. Authorities no fit give any clear answer about di sightings, dem just talk say e no be danger to di public or national security. “As time pass, e just dey worsen because of curiosity,” Ms Leavitt talk about di online rumors. “Dis no be di enemy.” Dis statement, wey Ms Leavitt talk for her first official press conference for Trump White House, na di most solid statement wey show say di phenomenon no get any bad intention. Di previous Biden administration self don conclude say e no likely get national security threat wey dey involved. Last December, di Federal Bureau of Investigation (FBI) talk say dem receive more than 5,000 drone sighting tips from citizens wey dey worry. Even di former Maryland governor Larry Hogan talk say he see plenty drones over im house. New York governor dey hype di state’s drone detecting technology to di residents wey dey worry. Di FAA con restrict drone flights over 22 cities temporarily till January. Di previous Biden administration don confirm say residents don spot drones and manned aircraft, but officials don stress say no foreign involvement dey. Di FAA dey regulate drone use and flights for di US. Nationally, more than one million drones don register for use, according to di agency. About 409,000 dey for commercial use, while about 385,000 dey used for leisure.