
As per wetin leak from internal memo wey Reuters see, the proposed restrictions go divide affected countries into three groups: those wey go face complete visa suspension, those wey go get partial visa restrictions, and those wey need fix security wahala or face visa limitations. African countries wey dey for the list be:
Full visa suspension:
Citizens from dis African nations go face total ban on U.S. visa if dem implement di policy:
Libya, Somalia, Sudan.
Partial Visa Suspension:
Di second group include countries wey citizens go face restrictions on tourist, student, and some immigrant visas:
Eritrea, South Sudan.
Countries at Risk of Partial Suspension:
Di third group na countries wey fit face partial visa suspension if dem no fix security screening wahala in 60 days:
Angola, Benin, Burkina Faso, Cape Verde, Cameroon, Chad, Democratic Republic of the Congo, Equatorial Guinea, Gambia, Liberia, Malawi, Mauritania, Republic of the Congo, Sierra Leone, São Tomé and Príncipe.
Di Trump administration never finalize di list yet, and U.S. officials dey warn say e fit still change. Di proposed restrictions follow executive order wey Trump sign for January 20, 2025, wey dey demand stricter security check for foreign people wey wan enter di United States.
This move dey follow di 2017 travel ban wey mainly affect Muslim-majority countries. If dem approve am, di new restrictions fit really affect travel, education, and business relations between di U.S. and di African nations wey dey for di list.