
Donald Trump don move back to White House afta dem officially swear am in as di 47th president of di United States.
Di inauguration Day include a formal swearing-in ceremony as well as musical performances, celebratory parade and formal balls for evening.
Vice President JD Vance also take oath of office on Monday, joining Trump on stage to officially begin dia new administration.
Trump promise say e go get ‘historic’ day as e dey plan to sign ova 200 executive actions as e dey enta office.
For im inauguration speech, Trump say im go make “America great” again as e go work to build am.
“My administration no go forget di kontri, di constitution and our God. I go sign historic executive order today.”
“I go declare a national emergency for di national border. All illegal entry go stop and we go take all criminals back to wia dem come from.”
“We go be a rich nation again. You go fit buy cars of your choice. We go begin tax foreign kontris to enrich our pipo.”
“We dey bring back free speech to America. Na only two gender go dey- male and female.”
How di inauguration waka
Donald Trump arrive for di Capitol, wia di main proceedings of di inauguration dey take place.
Biden and Trump waka for di middle of massive convoy of various police and secret service vehicles.
And around dem, di streets dey lined up by hundreds of personnel, designed to keep di two top men of di kontri safe.
E waka inside wit outgoing President Joe Biden by im side.
Alreadi, former US presidents and politicians don arrive for di venue of di inauguration.
Meanwhile, no be long drive from di White House to di US Capitol, but di presidential limousine wey Donald Trump and Joe Biden share today bin waka slowly.
Plenti supporters and fans bin gada for di Pennysylvania Avenue route ahead of di inaugural parade today also.
Meanwhile, due to di cold weather, all di ceremonies bin move indoors and dem create a public viewing area for one sport arena.