
Seven countries don book dem tickets out of the 48 wey dey available, as four teams sabi their place during di last international break, even though some European teams never start dem qualifying yet. Japan dey lead as dem first qualify, dem secure dem spot with three games to spare after dem beat Bahrain 2-0. New Zealand follow dem, dem take 3-0 win over New Caledonia for di Oceania final. Iran too qualify after dem draw 2-2 with Uzbekistan, while di defending champions Argentina seal dem spot with correct 4-1 win over Brazil. In total, seven teams don qualify, including di co-hosts – United States, Canada, and Mexico – wey just collect dem places. E go still take over one year before all 48 teams confirm, as di new World Cup go allow more teams from each continent qualify pass before. Di final go happen for New York New Jersey Stadium on 19 July 2026, na di second men’s World Cup final for USA, after di 1994 one.