
South Africa don officially come shock all American businesses wey dey for dem territory and don stop to export minerals go United States.
This one come just few days after Donald Trump cut all funding wey dey come from US to South Africa and the USAID too. South African government don make am clear to Trump sey America no go fit survive without minerals from Africa. If e think sey Africans be just beggars, make e go search for minerals for another place because Africa don tire for all this disrespect wey dem dey show. US dey make over $25-billion profit from South Africa every year. This one go really shake both American and South African economy bad. No African country don ever stand up to United States like this before. South Africa dey do well!